Apapa ·
Balogun or Instagram vendor: who don cheat you pass?
Make we talk true. Balogun, you go sweat, dem go drag your hand, but you go see the thing with your own eye and price am. Instagram vendor go post fine picture wey her cousin snap for abroad, then you go receive wetin be like the younger brother of wetin you order. I sell for market so I get bias. But my own daughter still dey order wig online. Which one don do you pass?
Vote to see results · no account needed